|
featuring 200,000+ song lyrics and 15,000+ artists
|
|
|
Eh Hen lyricsby Ruggedman
''Ehen!!''
Why you too dey rap like Mumu? (2x) ''Ehen!!'' Wetin concern Dudu and Fufu? ''Ehen!!'' God don catch you somebody don blast you ''Ehen!!'' Why you too dey copy copy? (2x) ''Ehen!!'' Abi your name na floppy floppy? ''Ehen!!'' God don catch you Ruggedman don blast you good for you. No more games I go go straight I go name names I no go lay blame na time to flog with cane I go let you feel pain and shame if I leave you and you still dey yarn your stupid game, dey shout your name like say na something good you disrespect?-you rude? I go slap you right here I no go wait for any mood Now Rasqie, how you take get deal pass me I no know wetin Kennis been hope to do by signin you Why? Ba lyrics,ba sense ba concept wetin e get? ''Nonsense'' You even talk say fakers dey out there out where? Sey where you stand? okay,yeah!!! See Kettle, calling the pot black like the Reverends ''Ayangba'' na another point of reference but I go take una one by one cos even the sun and the moon dey take am ''turn by turn'' As long as my wheel dey turn,my fire go burn I go call your name no matter where you are from or who you roll with or who you flow with no blame me I only see you as wetin you spit So if I call Rasqie a ras kid I know wetin I speak so make anybody no harass me for street if you do,e go too bloody cos my dogz dey with me some of them high pass Whitney and Bobby put together rock for the butter the bread the cheda whenever...mmh.. in short for ever You see me dey come through you best dey run too cos ma crew's gonna run through you like a runnaway ''Choo Choo'' If you like the beat ''Gbon idi'' Rasqie do the track but him gan him no Soji I say if you like the beat ''Gbon idi'' Rasqie do the track but him gan him no Soji CHORUS: No be secret say Remedies been need remedy I hear their rap I laugh to me na like comedy Eedris and my five year old nephew rap the same way like say dem born dem on the same day Wetin him dey talk I no hear but I fear when him migidi and people start to cheer I say wetin him dey try say for so long? Him name na Eedris how come him sabi speak in tongues? I speak too strong to be lyrically weak so if I die na of lyrics I go dey reek So Eedris.. here's a word of advice try using words and you just might sound nice But not as precise as me and my guys infront of your eyes no try too hard cos we don already win the prize So no need to rush to grab the mic to dey bust no need to ............to step on stage just because Ti wa abinibi tie ability so make u no show your face for my vicinity with you... We fit make money before this year over by selling tapes and an Eedris opats decoder I say We fit make money before this year over oh. by selling tapes and an Eedris opats decoder Oya Maintain make we siddon make we yarn I loved your concept for ''Blah'' your video bam but after that... nothing else ninety percent of your whole album na from someone else Tune no be your own instrumental no be your own but thank God concept and language na your own (Yoruba) But how far with copy copy and over lifting? outside of Naija copy write law go be your in thing Your main issue record companies dem go rip you like tissue so where you think say that go leave you? Inside gutter and I sure say Bamo go scamper when katakata scatter yakata This no be beef talk cos if na im we go be topic wey market women go dey discuss for Race Course oya make we pause Imagine Maintain for yankee say dem wan perform,LL Cool J,Nas,Aaliyah wey don pai I love you guys and I know you got stuff to offer only,keep it original take ma words like a brothers See me like a Pastor putting y'all on the right track Ke de mail me nitori mo fe ka jo se track (e mail me oh!) |
|